Cobhams Asuquo – We go win (Corona) Lyrics


Cobhams Asuquo – We go win (Corona) Lyrics

My brother, my sister, papa, mama and pikin

Corona no big pass us, we go fight am we go win

As long as we remember to always do the right thing

Wash your hands, love each other, we go win o

Corona na the virus wey dey worry human being

E no get leg o but e dey waka from pesin to pesin

But we fit beat am, we fit stop am

If we maintain good hygiene

And practice social distancing

We go win o

No shaking hands with your neighbor

Blow them a kiss from afar

Use soap and water to wage war

Let’s show this thing who we are

We are special, we’re courageous

We are awesome human beings

We dey super, we get power

We can conquer anything

If we hear word and obey laws

And exercise discipline

Wash your hands love each other

We go win o

If e be like say you no well like e something dey do you

And you feel say, you believe say, e get as e do you

An your body no gree soji like something dey do you

No let panic finish you

You go win o

Self-isolate for the sake of…

All the people wey you love ooo

Don’t go around spreading rumors

Cos fake news won’t help anyone

You are special, you’re courageous

You’re a kajad human being

You too much o, you get power

You can conquer anything

Only if you hear word and obey laws

And exercise discipline

Wash your hands, love one another

We go win o

My brother, my sister, papa, mama and pikin

Check:  Bishop Nehru – Like a Dream Lyrics

Covid-19 no big pass we, we go fight am we go win

Just as long as we remember to always do the right thing

Wash your hands, love each other, we go win o